As e dey Go

Gambling na youth empowerment: Naija youths react to EPL gambling advert ban

Published

on

After Premier League clubs ban the advertising of gambling companies on top dem jersey starting from 2026, some Nigerian youths don come outside dey react to the news and to wetin gambling mean to them.

You remember Premier League clubs agree to remove betting companies from the front of their shirt to help fight the problem of addiction wey don dey spread around the world.

For some Nigerian youths, the ban na welcome development because of the problems wey gambling dey cause:

John say: Wallahi tallahi, gambling don make many people look like mad men. Na so you go see some of them dey carry briefcase about like person we dey work for office, not knowing say na Bet9ja papers full the briefcase. Some of them sef, you go see sey their shoes don chop finish, with their faded trousers.

According to Sunday: This nah better thing ooo. Gambling done turn my landlord to tenant. Make Dem kukuma close all gambling games self

Presh confess say: I be one big example, nobody need to tell me wetin gamble fit do..thank God I respect myself stop before e take my life.

Many Naija youths believe say gambling na youth empowerment

But some people believe say the ban nonsense move because gambling naim be many people youth empowerment therefore betting no dey go anywhere.

Afam no get long talk because him point dey simple and straightforward: Oga betting don save more lives than Buhari government and am a testimony of that.

Nnamdi want make those clubs leave betting companies alone because: When I seriously needed money I beg taya but nobody show face. Na this betting I play for night wake up in the morning to notice say I don chop money wey change my pain to happiness.

Kosiso confess say him self na correct gambler and make dem free the matter: I’m a gambler too and I no go like make them ban am oooh. Na wetin men take dey chop be that! Yahoo no dey pay again, work no dey Nigeria and man must survive.

Thomas say na gambling be him alpha and omega: Make them no ban am oo. If not for bet I wouldn’t have achieved what i achieved in this bad country.

As for Chima, na gambling dey put food for him table: As far as them no ban gambling am good because na there I dey see food chop.

Some Nigerian youths also dey of the opinion say banning betting companies from front of shirt no go reduce anything, especially if sign board for stadium plus hand of jersey go still dey carry am.

Oluseye say: Gambling just no fit stop. Gambling dey as old as this world wey we dey so.. The soldiers even play Betnaija untop Jesus jalabia.

According to Dennis: This Matter no go change anything. As far as we dey concern gambling done enter everybody blood 💯.

Napoleon yan say: Betting has come to stay. With or without front jersey sponsor, betting go surely continue.

Hanesh conclude am say: This clubs just dey para upandan. Wetin be the use for remove Betway from West Ham jersey but all billboards dey carry betway during match? Person way like gamble go gamble, no be by advert.

Cornelius say make we help am thank him girlfriend wey help am quit gambling: Thanks to my girlfriend way say if I ever gamble again she go breakup with me. At first I no like the condition but now I don like am because bet don show me pepper. I been dey play bet of almost 10k every week ooo… I get account for bet9ja, betking, 1xbet, sportybet, bet360..
But since this year me way be gambling master no gamble again ooo.

As for Peter, him only prayer na make dem ban virtual because na da wan be the real gambling wey dey send people back to village: Abeg d ban dey very ok wit me, Abeg make dem ban virtual betting for all gambling platform, abeg dat tin don render plenty people useless. Abeg make Dem visit dat area.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version