As e dey Hot

Bet9ja, SportyBet and other betting companies go begin ask for NIN

Published

on

My people no be small sontin shele for we Naija House of Representatives drugs afternoon because the honourable dem there don move motion make betting companies like Bet9ja, Sporty Bet, Bet King etc, make dem begin ask me and you wey dey bet to register with National Identification Number wey be NIN.

Na one APC honourable from Ogun state, oga Isiaka Ibrahim naim carry dat motion come drop for house dis hot afternoon. According to oga Isiaka, the betting industry for worth up to 400 billion dollars and by the end of dis year e fit don cross 565 billion dollars which is more reason why dem need to make laws wey go make sure say youths wey dey do yahoo yahoo no begin use am take dey run things.

As this guy dey bet online so, dem fit just ask am to fill in NIN to continue

According to oga Isiaka, na 2 major reasons make am dey ginger make betting companies include NIN for dem registration. The first na to make sure say true true the people wey dey gamble there truly don cross 18 years wey be the age limit for gambling. The second reason na for money laundering because according to am, some kind drug dealers and Yahoo boys for use betting take dey do money laundering for the dirty money wey dem hammer. So NIN go make sure say dem fit identify anybody wey bet some kind hooge funds wey pass wetin normal gambler suppose to dey bet.

After oga Isiaka yan finish wey the house agree naim dem forward the matter to the House Committee on Governmental Affairs to make sure say the Nigeria Lottery Regulatory Commission begin implement the law sharp sharp. The funny thing be say na the owner of NairaBet, honourable Akin Alabi naim the chairman of dat committee wey go oversee the implementation of the new regulation.

So my people especially una wey dey play online game, make una no surprise if una betting platform begin ask una for NIN. No be dem fault, na wetin our lawmakers for House of Reps ask dem to do be dat.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version