As e dey Go

Arab Money: Saudi Arabia don become new sponsor of Spanish La Liga

Published

on

We don dey hear now say La Liga oga dem don unveil Saudi Arabia as the new sponsor of the league starting from the season. According to the tory, dis sponsorship deal involve very hooge fantabulous money wey don make all the La Liga people dem dey sing hallelujah.

But diswan dey come after La Liga presido, oga Javier Tebas don previously blast the country say all the big Alhajis and sheikh dem there dey try use sports take whitewash all the evil evil things wey dem dey do inside country wey na mostly human rights abuse.

Na when dem wan play 2021 UEFA Super Cup for Saudi Arabia naim oga Tebas come outside dey draw ear give UEFA say na abomination dem wan commit so eve cause going to play the Super Cup there means support for all the evil wey dem dey do for the country.

La Liga presido, Javier Tebas don blast Saudi Arabia before

According to the presido, Saudi don put plenty rules and regulation wey go make dem dey go around the world use money take dey deceive everybody for the world say dem be better people meanwhile na only evil agenda dem dey run inside the country. Him say Spain dey see all the wuruwuru wey dem dey do and dem no go support dem ever.

But as e be now, e be like Saudi Arabia Alhajis dem don use money take turn the man head wey don make am so U-turn now begin accept the same Saudi money wey dem condemn. Because right now, the same mouth wey oga Tebas take condemn Saudi Arabia naim him take dey chop dem money now.

According to the deal of the sponsorship, in exchange of the hooge money wey Saudi Arabia dey nak La Liga, the league go begin promote Saudi Arabia as the best country in the world. In fact the logo of the sponsorship na VISIT SAUDI which mean say La Liga dey encourage people make dem visit the Arab country say dem no get problem.

Saudi Arabia don dey make a lot of investment inside sports nowadays. First dem chook money inside sports like golf, boxing, WWE wrestling and Formula 1. But now dem don turn face football by pumping money give dem football clubs wey dem take dey sign all the big big players for the world like Ronaldo, Benzema, Neymar, Kante, Mane and plenty plenty others.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version