As e dey Go

AFCON 2023 Roundup: Cape Verde shock Ghana, Egypt and Nigeria escape with draw

Published

on

The African Cup of Nations (AFCON 2023) don dey gather momentum as we don begin see different different kind of shocking results wey go show you say for African football nobody dey look Uche face.

And na Cape Verde naim record the biggest shock of the competition so far after dem kpokpo Ghana 2-1 for dem Group B opener wey shele inside Ivory Coast there. Cape Verde no waste time begin show Ghana shege when Jamiro Monteiro launch the goals inside only 17 minutes to make am 1-0.

VAR disallow gone goal for Ghana inside first half before Alexander Djiku use one correct header take make am 1-1 early inside second half. But Ghana collapse from there as Cape Verde begin press dem neck with possession sotay dem keeper make two correct saves.

But na for the 92nd minute naim village people remember Ghana and na defensive error naim dem do take dash Garry Rodrigues free goal to tap into empty net make am 2-1 and collect all 3 points from the match. As e be now na Cape Verde dey top Group B with 3 points.

Cape Verde players celebrate dem winning goal against Ghana

For the other AFCON 2023 Group B match wey shele on Sunday, January 14, Egypt sweat water and blood, even need late penarity to finally collect one point after dem play 2-2 draw with Mozambique. Na Egypt first go call police for dat match when Mostafa Mohamed score inside 2 minutes to make am 1-0 for dem.

But Mozambique show dem say no be who first call police dey win case with two back to back goals inside second half to make am 2-1. Na for the 97th minute naim VAR approve penarity for Egypt wey Mo Salah convert to save one point for Egypt.

Victor Osimhen score then miss chances wey Naija for take win Equatorial Guinea

For the early kickoff wey shele that day, Naija big striker, Victor Osimhen miss correct opportunity to win the match as the Super Eagles of Nigeria draw 1-1 with Equatorial Guinea for Group A. This one na after the same Osimhen don use instant equalizer take draw 1-1 after E/Guinea take the lead.

The Super Eagles go play AFCON 2023 hosts wey be Ivory Coast on Thursday, as dem need just a draw to keep dem qualifying hopes alive.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version