As e dey Go

To beat Shooting Stars for Ibadan sweet like amala and ewedu- Enyimba

Published

on

Nigerian Professional Football League don dey high tempo and after Enyimba enter Ibadan go beat Shooting Stars 2-1 for them own backyard on Sunday, Enyimba don use their social media handle take dey troll their opponents say to beat them sweet pass amala and ewedu.

As per the match wey shele for the Lekan Salami Stadium, the first half end goalless. Na for second half naim referee award Enyimba penalty wey Chijioke Mbaoma convert to make am 1-0 for the People’s Elephant.

Kareem Ademola equalise for Shooting Stars in the 83rd minute before Chibueze Izuogu use one better outside cannon take scatter Shooting Stars net to make am 2-1 for Enyimba in the 95th minute to seal all 3 points for the Aba club away from home.

Shooting Stars feel say dis rough suppose be penalty

Shooting Stars no go too happy with the match because e get one penalty wey dem believe say ref suppose award and then the same ref disallow one of them goals. But this one no stop Enyimba from using the opportunity take stroke their bitter rivals from the West. According to Enyimba:

This victory sweet even more with amala and ewedu plus gbegiri and plenty shombo, elude and roundabout inside. Make e come be amala wey dem make for Ibadan, na da wan be ultimate.

Some fans don dey react to the post. One Shooting Stars fan, Adewale tell Enyimba say abeg as una don choke us so, make una leave us make we breath small.

Another fan say to balance the equation Shooting Stars suppose to win Enyimba for Aba and then troll them say revenge is best served with nkwobi. Whether Shooting Stars go fit run am so naim be another problem for another day. For now make we enjoy the bants.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version