As e dey Go

Thiago Silva wife say Chelsea need one Silva for midfield and another one for attack

Published

on

After Fulham beat Chelsea 2-1 for them west-London derby wey shele last night, Thiago Silva wife, Isabelle don come outside dey cry and complain say the other Chelsea players no dey do them work and carry the team the way her husband dey do am.

Thiago Silva don become one of the best Chelsea players since him join the club for 2020 under former coachie, oga Thomas Tuchel. And although at 38 years old the Brazilian defender na the oldest player for the squad, the man still get work rate pass everybody else.

But him work rate no stop Chelsea from losing losing 7 out of them last nine matches. Neither did it stop them from losing last night against Fulham wey everybody expect say them go win because of them new signing, Joao Felix wey them just collect on loan from Atletico.

But na that Felix gan-gan turn out to be Chelsea problem after the bobo chop straight red card to become the 22nd player for EPL history to collect red card for them debut. Fulham quickly take advantage when Vinicius head the winner inside net while Kepa dey dance kerewa.

Aunty Isabelle shed tears after Fulham kpokpo Chelsea 2-1

That loss make am 7 losses in the last 9 matches for Graham Potter boys and na this worwor record don make Silva wife come outside dey weep and lament say make this club no kill her husband for her. According to Aunty Belle:

Oh my God see as Chelsea dey break my heart make me dey cry like small pikin. If only we get one Thiago Silva for attack and another one for midfield, all this nonsense igbakugba no for dey happen. But my husband cannot coman goan kill himself and na the problem be that.

Many Chelsea fans dey pray make oga Todd Boehly sack Potter but e be like say the billionaire owners never ready to deal with da wan yet.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version