As e dey Go

Tanzania agberos don rob Rivers United team bus ahead of dem CAFCC match with Young Africans

Published

on

As players and staff of NPFL champions, Rivers United don land inside Tanzania to take on Young Africans for their CAF Confederations Cup Quarter Final second leg, we don dey hear now say some hoodlums don attack their team bus and steal plenty people property.

According to the tory, na for midnight when people suppose to dey sleep naim Rivers United officials receive alarm say the bus wey suppose to dey carry dem go everywhere, from training pitch to hotel and stadium dey under attack.

By the time the officials reach there, dem see say the some agberos don attack the bus, steal valuables wey worth thousands of dollars, come still spray one bad toxic chemical like teargas wey go make nobody fit siddon inside the bus or even use am.

Rivers United na NPFL champions

According to the club social media handle: “Barely 24 hours to the kick-off of the #TotalEnergiesCAFCC quarter final 2nd leg tie inside Dar es Salam, naim agberos burgle Rivers United’s team bus steal valuables worth thousands of dollars.”

And according to one official inside the video, this no be the first time wey this same thing dey happen to Rivers United for Tanzania. For 2021, when Rivers United visit the country, dem also attack their team bus, even attack their dressing room and spray the same toxic gas inside.

So as e be now, the Rivers United players and officials dey expect say na the same modus operandus naim dem go still run again therefore dem dey expect attack on their dressing room for the match wey go shele later today.

Rivers United go enter the match with disadvantage after losing 2-0 for the first leg wey shele back home for Naija. Na diswan make many people go dey wonder say if Young Africans don already beat Rivers for away, why dem need to do all dis wuru-wuru now for their own backyard?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version