As e dey Hot

Super Falcons dey plan boycott dem first World Cup match due to unpaid bonus

Published

on

No be small sontin dey shele inside the camp of Naija Super Falcons as we don dey hear now say the players dey plan to strike like NLC and boycott dem first match because the Nigeria Football Federation (NFF) tell dem say dem say dem don cancel their match bonuses for the full competition.

Na yesterday naim gbege burs when Super Falcons coachie, oga Randy Waldrum use serious provocation take come outside dey chook correct hand inside NFF eyes say dem wucked well well because for the past 2 years, dem never pay Super Falcons 1 naira as match bonus.

Oga Waldrum also accuse the NFF oga dem say no difference between dem and Naija politicians because only dem tiff all the $960,000 wey FIFA give Naija to take prepare for the FIFA Women’s World Cup wey go shele inside Australia and New Zealand. When we calculate dat money na about 720 million naira.

Finally, the man also accuse NFF say for the past 14 months dem no pay am salary and dem no even bother how him take dey take care of him family. The man say the only reason why him never dump the Super Falcons job na because of the love wey him get for the girls, if not, him for don waka since.

The NFF oga dem sef don reply am say him na secondary school coachie wey him highest achievement na to carry Falcons go World Cup. Dem say na only manage dem dey manage the coachie and if him talk anyhow him go see anyhow.

But now, e be like say the girls dey support dem coachie because right now dem don promise to abandon dem first match if NFF no ready to pay dem. Nigeria suppose kick off dem campaign on Friday July 21 when dem suppose face Canada by 3pm Naija time. Na to see wetin go shele dat day.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version