As e dey Go

Sadio Mane don buy football club inside France

Published

on

We don dey hear now say Senegal striker, Sadio Mane don buy one football club inside France wey dem dey call Bourges Foot 18. The club dey play for the fourth division of French League.

According to the tory, e don tay wey Sadio Mane don dey find club wey him go buy but e no work out until now. And the former Liverpool winger no be stranger for Bourges Foot as him don dey donate money give the club right from time to help dem pay salary and buy players for more than 3 years.

Na all dis good-good things wey him dey do make am become paddy with the owner of the club as well as the mayor of the town wey the club locate. And as e be now, the club president don kuku advise am to close eyes buy the club so dat him go begin control the club fully.

Mane currently dey play for Al-Nassr inside Saudi

Bourges Foot 18 currently dey second to the last for Group B of French fourth division. But the club been dey perform better pass like dis, in fact the club don play for Ligue 2 before wey be the second division of French league. But since then things no go well with dem wey don push dem enter Division 4 so.

But as e be now, the club president and Mayor of the town believe say the way forward na to sell the club give Sadio Mane. And Mane sef wey start him football career for France, don tell dem say him plan na to reorganize the club and return am back to dem former glory.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version