As e dey Go

Referee wey play 42 minutes added time for Bolivia League don chop suspension

Published

on

The whole world of soccer shock on Monday when one Bolivian referee, Julio Gutierrez nak 42 minutes of injury time during one league match wey shele inside the country top flight.

Na during the match wey the away team, Blooming, been dey lead 2-1 towards the end and then Palmaflor wey dey home score equalizing goal wey VAR ask referee to check well. The ref take very long to check TV before awarding the controversial goal, 2-2.

But the gbege no end there because as some Blooming players begin protest against the decision naim one of them chop red card. Then as the match continue naim ref nak another Blooming player red card wey make the team provoke begin fight referee and other officials.

By the time them manage settle the fight, the match continue long after the 90 minutes sotay people begin wonder which kind match be this one wey no dey gree end? Shay pesin die ni? Even if ref wan rig the match, diswan don too much.

The match turn to Street fight at some point

Na for the 128th minute naim Palmaflor finally manage score the winning goal to make am 3-2 and 4 minutes later the ref end the match. By the time we look our clock, na 42 minutes added time naim dem play and the match last a total of 132 minutes.

Immediately after the match naim the two clubs begin complain say the referee do them ojoro. Even Palmaflor wey na them the added time and two red cards favour follow blame the officials say them do ojoro.

In the end, Bolivia Football Federation don review the match and based on them preliminary findings, don suspend the referee, Julio Gutierrez. Them also suspend the two assistant referees, the fourth official and the two VAR refs until further notice.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version