As e dey Go

PSG players reject Mbappe, vote Marquinhos and Pereira as captain and assistant

Published

on

We don dey hear now say PSG players don reject Kylian Mbappe when dem vote for who to make dem captain for the season. Because after the voting, na Marquinhos emerge as the captain as most of the players vote for am to continue as captain.

As the voting take go, na Danilo Pereira carry second which mean say na him be assistant skippo. Kylian Mbappe no even see third place sef because na Presnel Kimpembe naim carry third while Mbappe manage fourth position.

Una remember say many PSG players dey vex for Mbappe after one kind capping wey him go cap say PSG no ever fit win Champions League because dem no get the pedigree.

While the thing explain why Mbappe wan run leave PSG go Real Madrid, e still no go well with PSG players as dem use anger take protest go meet PSG oga dem to warn Mbappe to stop to dey bring bad vibes around the club.

PSG wey dey run loss of €348m still dash Mbappe 150m sign on bonus with new 3 years contract wey make am the highest paid player in the world and also give am mouth to decide which coach and which players to hire or fire

Kylian Mbappe no gree extend him contract with the club, insisting say him must leave on top free transfer after the end of season. Na diswan make the club vex put am for market say dem must sell am now so dat dem go fit make small money on top him head.

Saudi club, Al-Hilal bid £259 million to make Mbappe the most expensive player in history just to play for dem for one year but the bobo turn dem down. As e be now, the player don finally settle with the club and him don return to dressing room but we no know wetin be the arrangement.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version