Wetin shele gan-gan

Pep Guardiola follow spoil German football with tiki-taka – Schweinsteiger

Published

on

Former Germany international, Bastian Schweinsteiger don come outside dey point accusing finger inside Pep Guardiola eyes say the Manchester City coachie follow for the reasons wey make German football spoil and scatter sotay the country no dey progress for international competition.

The last time wey Germany win any meaningful trophy na 2014 when dem win the World Cup inside Brazil. Since then, nearly 10 years later Germany never even attempt to see dem period.

Dem jabo from the semifinal of the Euro Cup wey shele for 2016. The 2018 World Cup inside Russia na disaster because na from group stage Germany jabo. For Euro 2020 dem manage reach second round before dem jabo. Then dem enter the last World Cup for Qatar go flop again as dem jabo for group stage.

Na all diswan don make people dey shake head say wetin dey happen to Germany no dey ordinary but Schweinsteiger don put some of the blame on top Pep Guardiola head say na dat bobo naim change the style of German football during him time as coachie of Bayern Munich.

Schweinsteiger dey accuse Pep say him follow spoil German football

According to Schweinsteiger, E get reason why dem dey call dem German Machine. Na because anybody wey wan play against Germany know say dem must ready to run for 90 minutes because Germany no dey taya. Dem ready to chase long ball from here to Okoko and na Germany football value be dat.

Schweinsteiger say na when Pep Guardiola join Bayern Munich naim dat values begin change:

”All of a sudden everybody wan play Pep style of football. German players begin play short-short pass dey call am tiki-taka. While e help am win league title and the rest of which even me sef enjoy, as a national team, dat Guardiola tiki-taka make us lose our values.”

Schweinsteiger play 2 seasons under Pep Guardiola for Bayern before leaving to join Manchester United for 2015. Guardiola leave Bayern join Manchester City for 2016.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version