As e dey Go

Nottingham Forest agree to pay £20m take sign Emmanuel Dennis from Watford

Published

on

Nottingham Forest don finally agree to sign Naija and Super Eagles striker, Emmanuel Dennis from Watford on top bride price of 20 million pounds. Diswan na big money especially for player wey him club suffer relegation last season.

But na the same fear of relegation dey push Nottingham Forest wey make dem just dey sign players like say dem wan win champions league. As dem just gain promotion enter EPL so, dem no plan to return back after dis season which is why dem dey hustle to buy players wey go help dem survive.

Emmanuel Dennis na Naija player wey don dey become regular for Super Eagles

 

Emmanuel Dennis sef carry plenty hype follow body for Watford last season. Although him start well with the hype we make am score 8 goals inside him first 18 league matches last season, the hype later off when the bobo manage only 2 goals inside the last 17 matches.

Na diswan make many people begin wonder whether this bobo really special like that abi na just too much vibes and insha Allah. But diswan no stop Nottingham Forest from cooking eyes on top Emmanuel Dennis matter even though him never score for Watford 2 matches dis season so far.

Nottingham Forest lose dem first EPL match 2-0 against Newcastle on Saturday. Dem go dey hope to grab dem first EPL points when dem host West Ham for dem backyard on Sunday. We no come know whether Emmanuel Dennis go don available to play dat match by then.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version