As e dey Hot

Naija Boy Umar Sadiq to join Real Sociedad from Almeria on top €25m contract

Published

on

Naija Super Eagles striker, Umar Sadiq don join Real Sociedad from Almeria on top 5 years marriage contract. According to the details of the contract, Sociedad go pay 25 million euros to take sign the big striker.

Umar Sadiq na 25 years old number 9 wey don waka for Europe taya. After finishing him Academy for Football College for Abuja, Umar decide to try him career for Europe by joining Spezia but na then him waka-waka start.

The bobo waka go loan for many different clubs for Italy including Roma, Bologna, Perugia, Torino and some sef wey we no too sabi dem name like Lavagnese. When dem run out of clubs to send am inside Italy, dem begin send am on loan outside to clubs like NAC Breda for Netherlands, Rangers for Scotland and Partizan for Serbia.

Umar Sadiq don become regular player for Super Eagles

Na for Partizan him later settle score 6 league goals inside 10 matches wey make Almeria run sign am. Na for Almeria the bobo finally blow, scoring 40 league goals inside 79 matches wey help dem win Spanish second division and gain promotion back to La Liga.

Na dis goal scoring record make Real Sociedad wan rush the Naija boy like hot Indomie so. As e be now, na Umar Sadiq go replace Alexander Isak wey Sociedad sell to Newcastle. And according to Sadiq contract, Almeria go get 25 percent of any money wey Sociedad sell am in future.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version