As e dey Hot

Naija Boy Chuba Akpom don win Championship Player of the Year

Published

on

Naija blood and Middlesbrough of England striker, Chuba Akpom don win the English Championship Player of the Season for the award event wey shele last night.

Akpom score 29 goals in all competitions this season to become the first Middlesbrough player to score more than 20 goals inside one season in more than 30 years.

But if dem tell you when season start say this boy go later perform this kind wonder you for no believe am. This na because from when season start for May until June 2022, Akpom no even get jersey number talkless of to dey see bench. Na diswan make many people expect the former Arsenal man to leave the club go find greener pastures elsewhere.

But as God may have it, Middlesbrough sack their coachie then, oga Chris Wilder and bring in Manchester United legend Michael Carrick as dem new coachie.

Chuba Akpom score 28 league goals for Middlesbrough

Na then things begin turn around for the former Arsenal academy player as the bobo begin bang goals anyhow until ending up as the Championship top scorer with 28 goals. Him closest rival, Viktor Gyokeres of Coventry don score only 20 goals.

And during him acceptance speech, Chuba Akpom confess say the coachie (Michael Carrick) turn up at the right time because if not, things for worwor for the club and the player. According to Akpom, Carrick convert am to Number 10 wey turn am to beast.

Middlesbrough wey currently dey 4th for Championship table dey fight to gain promotion back to Premier League. With 3 matches to go, e dey almost impossible say dem go overtake second-place Sheffield United which means say dem go need to settle for the playoffs as their only hope of promotion.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version