As e dey Go

Make nobody blame Lampard, Guardiola and Mourinho no go do pass am – Makelele

Published

on

Chelsea legend, Claude Makelele come outside dey draw ear give everybody wey dey criticize Frank Lampard say make dem leave the poor man alone to focus on him job, after all, even Pep Guardiola and Jose Mourinho no go do pass wetin Lampard dey do.

E shock many people when Chelsea name Frank Lampard as the coachie to take over the club after dem sack Graham Potter. Before then, Frank Lampard don lose 7 and draw 2 of him last 9 matches as Everton coachie wey make the club sack am.

Therefore many people believe say Chelsea just jump from frying pan enter fire. Lampard himself no kuku disappoint them because him start him second term with loss and na so e continue for the next six matches sotay people begin wonder whether no be relegation the man dey carry dem go so.

Chelsea finally secure the first points of Lampard second term as Chelsea coachie when The Blues beat Bournemouth 3-1 away. That win also remove them from relegation battle as the 41 points make am mathematically impossible to suffer relegation.

Claude Makelele na former Chelsea midfield jagaban

Yet e no stop many fans from criticizing the man say him na carpenter wey just dey parade himself as coachie. Na wetin don make Makelele come outside dey defend Lampard say no other coachie go do pass wetin him dey do so. According to the former Chelsea midfielder:

”Instead of to dey blame Lampard, una suppose to dey hail am. Because dis job wey him collect na job wey go cripple many coachie dem career. Even if you carry Pep Guardiola or Jose Mourinho put for dis particular situation, dem for still flop.”

According to the former Lampard teammate for Chelsea, na new players full this Chelsea team. Many of dem never play for big club like Chelsea so dem still dey find their way. Lampard no know dis players before now yet him still get mind collect the work. As such the man deserve praise not castigation.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version