As e dey Hot

If Kano Pillars try any violence, dem go return back to relegation – NNL chairmo

Published

on

As Kano Pillars don finally regain promotion back to Naija top flight wey be the Nigeria Professional Football League (NPFL), the oga of the All Nigeria National League Clubs, oga Chidi Okonkwo don come outside dey draw ear give dem say make dem avoid violence or else wetin happen to dem last season go happen again.

Kano Pillars wey be former 4 times NPFL champions suffer relegation for the first time in 20 years for the 2022 season and na because of the violent behavior of dem officials and fans.

Because na towards the end of the season when dem host Dakkada FC for Kano, when Dakkada score late equalizer naim Pillars chairman, Surajo Yahaya attack the referee of the match begin beat am dey punch him face like Mike Tyson.

Before long dem fans don pack enter pitch begin beat Dakkada players and officials sotay dem even break their cameraman cameras and other equipment. Na wetin make the league nak dem 3 points deduction and na wetin carry dem enter relegation zone with one match to go be dat.

Kano Pillars don return bac to top flight after vawulence carry dem go relegation

But now, Pillars don hustle their way from relegation back to the top flight and the oga kpatakpata of the Nigerian National League (NNL) don warn dem to continue dey behave like people wey get home training or else wetin happen last time go happen again.

“The reason why Kano Pillars and their fans comport demsef well like Nursery school children na because we for NNL also introduce strong rules and regulations wey make everybody head correct. So I go advise dem to continue to dey comport demsef for NPFL because once dem make any mistake, NPFL go relegate dem sharply back to NNL.”

Oga Okonkwo also remind dem say the Interim Management Committee of the league also do many changes in the league which is why you hardly hear of any violence dis season. So make Kano Pillars no go there go press spoil.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version