As e dey Go

I dey remind Victor Osimhen everyday to join Chelsea- John Obi Mikel

Published

on

Former Super Eagles skippo, John Obi Mikel don come outside dey shalaye say na almost everyday him dey chat Victor Osimhen dey remind am say make him no join any other club wey no be Chelsea because na club wey go favour am be that.

Osimhen wey be the current African footballer of the year dey currently play for Napoli but everybody believe say soon and very soon the Nigerian hit man go need to leave the club for something bigger.

And Mikel wey be former Chelsea player and legend after him carry them win Champions League believe say na him former club go fit Victor Osimhen pass. According to Mikel:

I know say many other clubs dey chook eyes for Osimhen matter. Clubs like PSG, Liverpool and even Manchester United dey toast am. But I believe say if you watch Chelsea now, our problem na say we no sabi put ball inside net. And the only work wey Osimhen sabi na to put ball into net. If that bobo come Chelsea, walai talai him go blow pass Timaya.


Mikel Obi also say na him dey act as Victor Osimhen agent for this parol. Him say Osimhen fit no be the most flashy player wey too skillful. But just like Haaland, Osimhen sabi put ball inside net and na wetin make am be big player be that.

Victor Osimhen na sharp shooter wey score 26 goals take help Napoli win Italian Serie A for the 2022/23 season. So far, the 25 years old striker don score 13 goals inside 21 appearances for Napoli this season including the hat trick wey him score against Sassuolo for Napoli last Serie A match.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version