As e dey Go

Super Eagles go beat Cameroon like small pikin- Segun Odegbami

Published

on

As AFCON 2023 don enter knockout stage wey them don pair Nigeria to play Cameroon for the Round of 16 so, Super Eagles legend, Segun Odegbami don come outside like KingKong dey beat him chest say this Cameroon match go too easy for Nigeria because we go beat them like small pikin.

This one dey come after the AFCON wey dey happen inside Ivory Coast progress from the group stage enter knockout stages. This talk confuse many people because even for the group stage self, the Super Eagles no really impress as them manage to score only three goals in their three matches still finish second for the group.

On top of that the ball wey them dey play no even dey sweet for eyes make we say na that one we take hold body self. But on top of all of this, Mathematical Segun believe say Nigeria wey no dey give fans joy go easily beat and eliminate five-time AFCON champions, Cameroon from the competition.

Segun Odegbami believe say Cameroon no be Nigeria mate

According to Odegbami:

Na this Cameroon wey everybody dey fear naim go be our easiest match for this AFCON. Because all those their gidigbo football wey them like to dey play no go work for this new stadium wey we dey go. The former stadium wey them been dey play rough like farmland. But na this smooth pitch naim we go catch them take show them correct pepper.

Segun Odegbami also talk say the Super Eagles dey improve for them game because after drawing their first match them win the last two. According to the legend, na progressive that so no shaking for that Round of 16 match.

Nigeria go play Cameroon for their Round of 16 match wey go happen on Saturday by 9pm Nigeria time. Wetin you think about that match? Abeg tell us for comment section.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version