As e dey Go

I blame Manchester United fans for Maguire condition- Brendan Rodgers

Published

on

Harry Maguire former coachie for Leicester City, oga Brendan Rodgers don come outside dey point accusing finger inside the face of Manchester United fans say na dem him dey blame for the tough times wey the central defender dey pass through.

Rodgers coach Maguire for less than a year for Leicester, but that time dey enough for am to know the kind player wey Maguire be. But since the former Leicester City defender move to Old Trafford on top 80 million pounds waka, Manchester United fans no understand am at all because na calamity upon calamity dey follow am.

But even as him dey fumble for Old Trafford, England National team coachie, oga Gareth Southgate still dey always invite am to National team as a starting defender, even for the last World Cup wey shele inside Qatar. And the guy dey always perform for National team, although him score own goal for dem last match.

Manchester United fans no gree Maguire drink water drop cup last season as dem jus dey blame am for all the bonanza wey United defence jus dey do last season

But na dis off and on performance between Old Trafford and National team make Brendan Rodgers believe say na Manchester United fans dey insult Harry Maguire wey make other fans kuku get mouth dey join dem because charity begins at home. According to the Celtic coachie:

Na Manchester United fans be Maguire problem o. I’m telling you. Na as dem dey insult the guy naim other fans dey learn from. How player wey be top class for Leicester wey make United buy am for 80 million, top class for national team, yet na only for Old Trafford him no be top class? Na the club be the problem, not the player.

Oga Rodgers even praise Maguire say him dey mentally strong because if na some other players, by now dem go go don enter depression.

Harry Maguire dey face serious insults and mockery because of him performance for Manchester United. And recently, him mama come outside dey fight everybody including media people and Manchester United fans say wetin dem dey do him pikin, no human being deserve dat kind of treatment.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version