Wetin shele gan-gan

How Kanu Nwankwo start him Enyimba chairmanship with vawulence and confusion

Published

on

Naija legend and current Enyimba of Aba chairmo, Papilo Kanu Nwankwo don start him reign with some kind confusion mixed with vawulence after one internal memo wey leak show say the bobo ask Enyimba coachies and officials to send another application for dem jobs immediately.

According to the memo, both the coachie Enyimba team A and team B, plus their assistants and other officials don turn to job seekers because everybody must submit new application within the next 48 hours or….

Na Finidi George be the coachie of Team A and him just carry the club win Naija league last season. And na Kanu Nwankwo wey dem appoint as the new chairman of Enyimba about 2 weeks ago, naim be the sole administrator for the club now. The two of dem na correct paddi wey make many people dey believe say dem combination go work.

Finidi George just carry Enyimba win the Naija Football League

But with dat latest move of application again, many people dey wonder why Papilo go ask him friend wey just win League with the club to send application again for the job. Shay da wan no mean say Finidi no be the coachie again as of now since dem dey only ask for job application for job wey get vacancy and if dem dey ask Finidi to apply, dat means vacancy don dey.

Na diswan don make Abia State government come outside dey shalaye say Finidi George na still Enyimba coachie and nothing go change am. Inside the statement by the chief press secretary of Abia state governor, oga Kazie Uko, dem no sack Finidi George or anybody else o:

”Na lie o! We no ask anybody to sack anybody o. Finidi George na our coachie and na him still dey him charge. Same with other officials and staff. So make una fashi any kind information say we sack am, na big lie be dat.”

But the chief press secretary no address the matter of writing of application or no application wey Enyimba Sporting Director, with permission of the chairman wey be Kanu Nwankwo, ask dem to do. Make we sha dey watch the feem for now.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version