As e dey Hot

Guardiola say him no regret selling Jesus and Zinchenko to Arsenal

Published

on

As two former Manchester City players, Gabriel Jesus and Oleksandr Zinchenko don help Arsenal dey top Premier League table, 5 points on top their former club, their former coachie, Pep Guardiola don come outside dey yan say him no regret selling the two players to Arsenal at all.

Una remember say na before season start naim Arsenal coachie, oga Mikel Arteta go raid him former club sign both Jesus and Zinchenko from there wey two of them cost around £70m. And since the two players join Arsenal, them don dey carry the club like aboki wey dey carry yam.

Na this one don make many people dey wonder whether Pep Guardiola no regret why him sell those players especially as him boys dey even struggle to win matches nowadays. But the back to back Premier League winning coachie don dey clear them say him no regret at all.

According to the man: “Shay na because them dey win without me go make me dey regret selling them? No na. I no be bad bele. In fact na me even happy pass self say Jesus and Zinchenko dey do very well.”

Guardiola say him love Zinchenko and Jesus

Pep Guardiola say him love the two players even when them still dey Manchester City and na because condition don too make crayfish bend naim make am decide to sell the players go where them go dey happy. Him also talk say Zinchenko get many opportunities to leave City but him still decide to stay until Arsenal finally carry am.

Manchester City dey host Arsenal for FA Cup on Friday night and that go be the first time wey both Zinchenko and Jesus go play against their former club since them leave.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version