As e dey Go

Footballer turn drug baron don chop 6 years in prison for drug trafficking

Published

on

My people na different different things dey happen for this our world of football as we don dey hear now say one former professional footballer don chop 6 years prison sentence for leading one gang wey dey do drug trafficking.

40 years old Sergio Contreras wey many people dey call Koke na Spanish footballer wey start him professional career with Malaga inside Spain before going on to play for Olympique Marseille for Ligue 1, Houston Dynamos for MLS and Sporting Lisbon inside Portugal.

We no come sure whether na when him still dey play naim the bobo begin do drug trafficking. Wetin we know be say him form gang of 17 people including one woman wey dey work with am for the buying and distribution of drugs. Koke go buy drugs like igboh, cocaine and marijuana from Columbia and then resell am throughout Europe.

Koke wey be the ring leader, get many lorries and trailers wey dem take dey smuggle all these drugs around Europe. Dem go disguise say dem dey transport agricultural foodstuff like garlic and ginger and onions but dem don hide all those drugs with those things.

Load of cocaine

One trip of drug trafficking alone dey bring in $440,430. When we meet Aboki to convert this money, we see am say na about N330 million we dey talk about so.

But devil finally soda Koke and him drug trafficking gang for November of 2019 when Spanish police begin investigate dem come begin arrest dem one by one for one operation wey dem call Operation Vinculada.

Now dem matter don reach court and even though court been wan nak each of dem 16 years in prison, dem use beg beg take do plea bargain wey make court reduce am to 6 years with the agreement say none of dem go appeal the case.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version