As e dey Go

Flamingos of Nigeria don qualify for Women’s U-17 World Cup semi final for the first time in history

Published

on

Naija Women Under-17 team, The Flamingos of Nigeria don qualify for the semi-final of the FIFA U-17 World Cup for the first time ever after them beat USA 4-3 on top penarity for them quarter final match wey shele dis afternoon for Mumbai inside India.

Remember say for Group stage The Flamingos lose them first match 2-1 to Germany before beating New Zealand 4-0 and then Chile 2-1 to qualify from Group B.

The match wey suppose start by 12pm in the afternoon delay for nearly 2 hours because of one heavy rain wey dey fall for Mumbai inside India wey dem wan play the match. But las las the match finally start around 1.55pm.

American babes turn up like say them play pass our girls as them just first use tiki-taka take dey run our girls. But na the Flamingos score the first goal after VAR call the referee to check one small matching wey one American babe match one Naija babe inside 18 wey make ref dash Naija penarity.

The Flamingos of Nigeria win 2 of them 3 matches to qualify from the group stage

Edafe step up to loss the keeper and convert the PK to make am 1-0 for the Flamingos of Nigeria. But the lead no last because the American girls come outside begin play ball sotay Naija defence look like wetin wan collapse until one American girl, Villarreal hammer one correct shot wey deflect enter net to make am 1-1 after first half.

Naija enter second half begin try to play tikitaka like Manchester City use am begin press USA. Na so match kuku tie wrapper and before you know we begin hear language like “gba danu. Sonto the ball. Away!” When USA play corner kick you go dey hear ori e. And when USA miss one sweet opportunity naim the Naija keeper shout ope oooo!

In the end na penarity shootout settle the matter and although Folorunsho miss penarity for the Flamingos, the keeper, Nwakamma make one sweet save to help Naija break the jinx with 4-3 win and enter the semi final. After the match the girls begin sing praise and worship because true true, God hand dey inside this match.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version