As e dey Go

FIFA don open book on top Spanish FA Presido head for kissing female player

Published

on

FIFA nor go allow playboy behavior for football

Spanish Football Federation presido, Luis Rubiales don enter hot pepper soup wey FIFA dey prepare for am as the football governing body don dey investigate why him get liver kiss Spanish women captain, Jenni Hermoso for public during their World Cup presentation on Sunday.

Wetin Luis Rubiales do be sey him grab one of the Spanish female players, Jenni Hermoso, come dey kiss her like sey nah him wife. E nor end there, cameras come capture where him dey hold him gbola wey make am be man in front of the Queen of Spain and her daughter. All these dey happen after Spain beat England 1-0 take lift the Women’s World Cup on Sunday.

Nah this behavior don make FIFA disciplinary committee open investigation ontop him head. FIFA dey draw ear give am sey:

‘We don see am sey Oga Rubiales fall hand well well as we don put am for our constitution sey we nor go tolerate any kurukere behaviour from anybody. As e be so, we don dey investigate Oga Rubiales and we wan know wetin give am mind to dey kiss another man erima for public like that. We wan also ask am weda him wan start dey act blue film as we see am for camera dey hold him gbola like person wey konji wan kill’.

FIFA nor go tolerate any kurukere behavior for football

The matter don tie wrapper because the football federations inside Spain wey for help am settle the matter like Basque Football Federation don comot body for him matter. In fact, FUTPRO and aunty Jenni wey dem kiss don dey ask am to resign with immediate alacrity.

Jenni Hermoso reject to appear for video with am where him plan to use her take apologize for wetin him do but e be like nobody take am serious because him bin call people wey talk sey him nor do well to kiss the babe “idiot” and ingredients.

As e be so, e be like sey Luis Rubiales go collect wortorwortor for FIFA hand even if him don apologize for him playboy behavior.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version