As e dey Go

Na only idiots dey complain say I kiss female player – Spanish FA chairman

Published

on

After camera catch Spanish FA chairman, Luis Rubiales dey kiss Spain women player, Jenni Hermoso, and as some people don dey blast the man say why him go kiss the babe for lips when no be him wife, the chairmo don come outside dey tackle people wey dey blast am say all of dem na idiot dem be.

Na after Spain Women beat England Women to life the FIFA Women World Cup on Sunday, when FIFA president dey give the girls dem champions medal, dem give other girls but the FA presido no kiss any of dem. But immediately dem give Hermoso her own medal, the presido hug her then hold her face before giving her French kiss.

Immediately afterwards naim Hermoso wey also miss penarity during the final go her Instagram go post say she no understand wetin just happen and say she no enjoy the kissing at all.

Spanish FA president French kiss Hermano

Na diswan make many people begin blast oga Rubiales say which kind dirty old man him be wey him go dey kiss small girl wey old enough to be her granddaughter like that. One England female player even dey ask am whether if na man player like Pedri or De Gea whether the man go kiss him fellow man like dat.

But oga Rubiales don come outside dey defend himself say all those people wey dey talk those things na idiot dem be so make nobody listen to the nonsense wey dem dey talk. According to the man:

Walai talai I no know say idiots plenty everywhere like this o. So ordinary kiss wey man kiss woman out of happiness naim don make dem dey provoke? Which kind mumuness be that? Abeg make nobody disturb me. Spain don win World Cup and na da wan dey sweet me now, make nobody spoil my joy.

Jenni Hermoso herself don come outside dey change mouth from wetin she talk before say nothing dey bad for the kiss o. In fact the kissing dey very normal because na kiss of joy and celebration therefore make people no take am seriously again, make everybody face front.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version