As e dey Go

FIFA don nak Emmanuel Adebayor £500k settlement after him former club use ojoro take sack am

Published

on

Former Arsenal, Manchester City and Real Madrid striker, Emmanuel Adebayor don win FIFA case against him former club inside Paraguay League after him claim say dem use ojoro take sack am from the club. As e be now, FIFA don order the club, Olimpia, to pay Adebayor 420,000 pounds. When we meet aboki to convert da money for us, we see am say na about 213 million Naira naim Adebayor hammer so.

According to the tory, Adebayor join Olimpia for January 2020 just before Covid-19 spoil things for everybody. Na only 4 matches Emma don play for the club before lockdown happen and everywhere shot down including Paraguay league. When the league finally resume later for June, the club don already prepare sack letter down for Adebayor say make him carry himself comot from the club.

Emmanuel Adebayor playing for Olimpia

Adebayor beg dem to kuku pay am all him salary since then but the club no gree. According to the club presido, na 200,000 dollars per month dem dey pay Adebayor. Na the way dem take sack am like casual worker for one factory inside Agbara naim make Adebayor provoke carry the matter go meet FIFA.

Now FIFA don order the club to pay Adebayor 213 million Naira. Not only dat, FIFA also order the club to pay extra 12% interest for every month since June 2020 till now and we no even wan try to calculate how much da wan go be.

The case pain Olimpia presido, oga Miguel Cardona sotay him don begin provoke dey announce say from now, the club go change dem policy on top salary and allowance. E say from now, dem go get minimum wage and maximum wage and no matter which player join the club, whether na Garba Lawal from Ikotun or Cristiano Ronaldo from Portugal, as long as say na Olimpia be him club, him salary no go pass dat maximum wage.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version