As e dey Go

Fans of Botafogo for Brazil invade dem training ground with protest against the igbakugba wey dem club dey play

Published

on

My people no be small sontin dey shele inside Brazil as we don dey hear now say fans of Brazilian Serie A club, Botafogo don carry banner plus placard even carry plenty bundle of palm leaf take protest go meet dem players for dem club training ground. The fans dey protest the igbakugba wey dem club dey play wey don carry dem dey enter relegation zone for dem Brazilian league table.

Immediately the fans reach the training ground naim some Halogen security men try to stop dem for gate but dem show the security men say na dem get the club when dem sideline dem push gate open enter the training ground. When dem reach there dem see am say the players don run enter medical room so dem waka go meet dem there say make dem open the door and allow dem enter.

The fans say dem no come there to come begin spoil things or beat players o, mbanunu, it can never be us. Dem say dem own protest na to come talk to the players and officials and ask dem critical questions like; why dem no dey play well again? Shay dem no dey pay dem complete salary? Shay the coachie nor dey do dem well? Abi Shay dem no dey pay dem match bonus even though dem never deserve any bonus after losing dem last 4 matches.

Botafogo fan dey ask Botafogo player question for the interactive protest wey shele for dem training ground

The fans say dem protest na peaceful and interactive protest so make the players no fear because nothing to happen to dem. In the end the players open the door and the fans begin faya dem and the officials some serious questions. Na wetin dey happen when police wey some of the players don already call finally arrive but in the end dem no arrest anybody because nothing spoil and nothing loss.

Botafogo fans get every right to provoke because dem team dey struggle with relegation after only 12 points from 11 matches. Dem don lose dem last 4 matches join. Botafogo don produce some big big names for world football including the likes of Garrincha, Jairzinho, Didi, Gerson and Mario Zagallo. But nowadays the club no dey see dem period again after dem go relegation 3 times in the last 20 years.

Na diswan make the club Brazilian oga dem kuku sell the club give the owner of Crystal Palace, oga John Texor but even da wan sef no reach to save the club from the village people wey dey follow am so.

Check out dis story, you go like am well well: FIFA dey plan scrap throw-in from football, introduce kick-in

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version