As e dey Go

Even me wey be Togo best player, I no behave like Onana – Emmanuel Adebayor

Published

on

Former Togolese big striker, Emmanuel Adebayor don come outside dey blast Cameroon goalie, Andre Onana for joining them national team for the African Cup of Nations (AFCON) on the day wey them get their first match. Adebayor say wetin Onana do na big disrespect to the country.

Una remember say na on Monday wey Cameroon dey play their first match for AFCON naim Andre Onana finally join up with the Cameroonian national team for Ivory Coast. But that one no be problem because we don hear before say na agreement wey Cameroon get with Onana club, Manchester United be that.

The problem be say Andre Onana wey arrive on Monday still dey expect to start the match that same day, less than 24 hours after him last match for Manchester United against Tottenham, on top jet lag. But Cameroon coachie, Rigobert Song no gree start am say make him rest small, but that decision no sweet Onana at all.

Emmanuel Adebayor no like Andre Onana behaviour at all

Na this one don make Adebayor wey be Togo all-time highest goal scorer with 32 goals inside 87 matches don come outside dey blast Onana say, you should be ashamed of yourself. According to the former Arsenal and Manchester City striker:

Onana no respect Cameroon at all. Because if you respect your country, you no go dey come competition on the day wey your country get first match. No be you be the first player to play AFCON, during my time na me be the biggest player for Togo, but I no ever behave like this because na me dey always first come camp. Na so big player dey behave.

Cameroon later come from 1-0 down to draw 10-man Guinea 1-1 for them first match. Now them go face defending champions, Senegal for them second match on Friday and many people expect to see Andre Onana for post because that match na very important match wey Cameroon no need to lose.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version