As e dey Go

Desire Oparanozie wan join Adesanya and Usman begin fight UFC

Published

on

We don see footballers wey retire to pursue different kind opportunity like teaching, coaching and even driving taxi. But former Super Falcons striker, Desire Oparanozie don talk say the way she dey see am, e be like na to begin fight Mixed Martial Arts inside UFC naim be her next calling.

Oparanozie talk diswan during one event wey dem organize to celebrate her retirement from football at the age of 29. Although e be like say she use play play take dey talk am say she wan join UFC, but everybody know say na from play play naim seriousness take dey start.

Oparanozie no go be the first footballer to quit football begin fight because Manchester United legend, Rio Ferdinand been join boxing immediately after retiring from football. But after e collect beating like agbero for bus stop, Baba quickly retire from boxing too.

Desire Oparanozie no go also be the first footballer to leave football join another sport because Chelsea legend, Petr Cech retire from football keeper work go begin keep for ice hockey. Gareth Bale also retire from Real Madrid go begin play golf where him don even begin win titles there.

Desire Oparanozie go join Adesanya and Usman for UFC

If she finally decide to join UFC, Desire go dey in the company of many elite Nigerian athletes. Former champions like Kamaru Usman and Israel Adesanya dey there. Other Naija fighters like Sodiq Yusuff, Chidi Njokuani and Kennedy Nzechukwu also dey there.

But if you check all dis people well you go see am say none of dem be woman. So e no go bad if Desire Oparanozie become the first Naija woman to fight and maybe win belt for UFC. The problem be say, statistically, fighters wey leave other professional sports like American football etc, no dey too do well when dem join UFC. Maybe na our Naija sister go break the record.

Oparanozie na one of the most prolific strikers to ever play for Super Falcons. The babe help the Naija win 4 WAFCON trophies while playing inside 4 Women World Cup for Naija. She score 22 goals in 35 matches for Super Falcons.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version