As e dey Go

Crystal Palace fan wey danfo jam when celebrating dem win don kpai for hospital

Published

on

We don dey hear now say one Crystal Palace fan don finally die for hospital after danfo jam am for London while celebrating their win over Leicester City on April 1.

According to the tory, na after Crystal Palace wey dey fight relegation beat Leicester City wey be dem fellow relegation strugglers 2-1 for Selhurst Park naim the fan, Liam Foley, enter celebration mood with him brother.

Before we know wetin dey happen, the man don celebrate enter express like egungu wey make danfo take jam am. Him brother rush am go hospital but now we don dey hear say the fan don die from brain injury as a direct result of the hit wey the motor hit am.

We hear say the man been dey on life support since that April 1 until him finally give up the ghost. And right now, him girlfriend don decide to run for London Marathon in honour of the bobo.

Na for this road motor jam the fan die

Crystal Palace wey start their season well under former coachie, Patrick Vieira suddenly find themself playing igbakugba while fighting relegation. Na wetin make the club kuku sack Vieira be that, employ Roy Hodgson to become the new coachie.

And since joining the club, oga Hodgson don dey give the fans joy as him don win all the 3 matches wey him don play to finally remove the club from relegation zone up to 12th for Premier League table. Sadly, the joy wey him bring don lead to the death of this fan.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version