As e dey Go

Chuba Akpom no worth that £10.5m wey Ajax buy am – Neil Warnock

Published

on

Chuba Akpom nor worth £10.5m according to Pa Warnock

One of the oldest coaches for English football, Neil Warnock, don change am for Chuba Akpom as him don come out dey sey Chuba Akpom nor worth the £10.5m wey Ajax pay to Middlesbroigh to buy am.

Nah just last week Ajax do small something on top Chuba Akpom head after dem pay £10.5m to Middleborough to take carry am go Netherlands. Sheffield United and some other clubs both inside and outside England bin wan buy but nah Amsterdam him finally land.

Now, Neil Warnock use red eyes dey tell Ajax and Akpom sey:

‘Everybody know me sey I dey always talk true. You see that Chuba Akpom wey just go Ajax go still come back to England next year if Ajax play am as striker. If Ajax know wetin good for dem, make dem play am for number 10 role as Michael Carrick wey be Middleborough coach play am last season. In fact, Middleborough try to get £10.5m ontop him head’.

Warnock sey Akpom go return to England next year if Ajax play am as striker

Pa Warnock sey him dey wonder how Middleborough take toast Ajax convince them to pay that kind plenty money for Akpom because as far as him dey concerned, that money too much for am even though people like Caicedo go for £115m for this transfer window.

Nah Chuba Akpom be Championship highest goalscorer with 28 goals last season. Nah this thing dey make football people dey wonder weda Warnock use him clear eyes dey tell Ajax to play the bobo as number 10 wen actually him be number 9.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version