As e dey Go

Arsenal lokan: Cesc Fabregas say Gunners suppose win Premier League dis season

Published

on

Arsenal don turn jagaban for league

Former Arsenal and Chelsea midfield general, Cesc Fabregas don come out this early mor-mor dey sey this nah Arsenal year to finally win the Premier League title after nearly 20 years.

The last time wey Arsenal win the Premier League title nah their “invincible season” for 2004. Last season, Arsenal carry first for 248 days but nah Manchester City finally win the whole thing.

Fabregas wey dem dey call “Fabrepass” during him playing days nah coach now for Italo Serie B team Como where him dey coach their young players. Him hang boot after last season to concentrate on coaching. During wen him dey learn work, Mikel Arteta allow am dey visit Arsenal training ground and nah for there him confirm say Arsenal don ready to win league. Him say:

“Make I nor lie for una, this season nah Arsenal year to win league. This nah because since wey I dey go Arsenal training ground, wetin I dey see na wetin I never see before. The morale high well well. This Arsenal team nah the best for the past 12-15 years. E even better pass the invincibles. If dem nor win league this season, I go dey surprised”.

Cesc Fabregas don turn prophet

Arsenal beat Manchester City for their last league match after 12 straight losses and Fabregas sey Declan Rice nah the difference because him dey play like Rodri. Him say the bobo dey cover pitch wella and onto this, Arsenal go push all the way.

This talk don make football people dey tell Fabregas sey as him don decide to dey prophesy leave him coaching work, dem hope sey him prophecy nor go fail or dem fit do am wetin dem dey do fake prophets.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version