As e dey Hot

£70m wey Arsenal price no reach to buy Caicedo one leg – Brighton CEO

Published

on

Brighton CEO, oga Paul Barber don come outside with vawulence this hot afternoon dey blast Arsenal say the club been dey price Brighton midfielder, Moises Caicedo like market woman dey price pepper and the money wey them bring no reach to buy the guy one leg.

Una remember say na for December wey Arsenal lose Mohamed Elneny to injury naim them begin run kitikiti to find replacement. Na this kitikiti them run go Brighton to sign their midfielder, Moises Caicedo. Arsenal desperate sotay them offer Brighton £70m for the 21 years old Ecuadorian.

But now, Brighton oga kpatakpata don dey clarify say that £70 million no reach to buy the guy one leg talk less of the full player. According to the man, Arsenal no serious enough:

“Abeg make una help me ask Arsenal wetin that 70 million be for. Because if na to sign Caicedo, then the money no even reach to buy half of the player. Moreover, we no dey release how much wey them price our players so the money wey Arsenal bring fit no even reach £70 million.”

Brighton CEO say Arsenal money no reach to buy half of Caicedo

Moises Caicedo na player wey Brighton sign on top 5 years contract on top salary of £182,000 a year. This mean say Brighton dey pay am only £3,500 a week. Na this one don make many people dey wonder why the club decide to block the guy road.

As Arsenal no fit get Caicedo, them kukuma rush go buy Jorginho from Chelsea to cover for Partey and so far, Arsenal still dey do well.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version