As e dey Go

6 players + coachie chop red card as River Plate vs Boca Juniors end in vawulence

Published

on

No be small vawulence shele inside Argentina league as the Superclasico match between River Plate and Boca Juniors end with one big fight after which 6 players and Boca Juniors coachie, Jorge Almiron chop straight red card.

The match shele for River Plate home stadium, Estadio Monumental with 83,000 fans watching. Nothing happen for the full 90 minutes of the match sotay scores sef na 0-0 after 90 minutes. But na for injury time after ref award River Plate penarity naim things begin happen.

After all the arguments and disagreements with referee by Boca Juniors players, Miguel Borja convert the penarity to give River Plate the lead.

Immediately after the penarity, instead of to go celebrate with him teammates, another River player, Agustin Palavecino decide to celebrate by shouting inside the face of Boca Juniors keeper, and former Manchester United keeper, Romero.

Na diswan make Boca Juniors players rush Palavecino begin harass am, dey push am, be like somebody even tear am slap. E no tay before River players wey been dey celebrate realise wetin dey happen, begin rush come to help their man. And just like that street fight don set o.

Na Palavecino and Romero start the fight

The players begin throw punches, dey throw slap, dey shout for each other, before we know wetin dey happen dem don slam one player for ground and just like that, the fight don worse pass before as even the coaches enter pitch to put hand for the matter.

In the end na stewards and riot police manager separate the fight after 15 minutes of war. After everybody don calm down, referee nak 6 players red card, 3 from each side.

Agustin Palavecino wey start the gbege, Ezequiel Ignacio Centurion and Elias Gomez collect for River Plate. Na Miguel Merentiel, Ezequiel Fernandez and Nicolas Valentini collect for Boca Juniors. Romero escape even though na him punch somebody put for ground.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version