Wetin shele gan-gan

Super Falcons kpokpo Burundi 4-0 take qualify for WAFCON Q/final to play Cameroon

Published

on

The Super Falcons of Naija don qualify for the quarter final of the Women Africa Cup of Nations wey dey shele inside Morocco after dem kpokpo Burundi babes 4-0 for the third and last match of dem Group C.

Nigeria wey get only 3 points before then after losing dem first match 2-1 against South Africa and winning the second one 2-0 against Botswana need to secure all the 3 points to push demsef enter the quarter final. And the babes no disappoint at all.

When Super Falcons dey celebrate dem 2-0 win against Botswana for dem previous WAFCON match

Na Rasheedat Ajibade start the dance when she convert from penarity spot to make am 1-0 after only 25 minutes. Three minutes later naim Peace Efih double the scores for the girls. Uchenna Kanu make sure say the first half end 3-0 with her first goal of the night and the competition.

Immediately second half start naim Kanu score her second goal to make am 4-0. She get opportunity to complete her hat trick but Burundi keeper no gree. The keeper later get injury and many people tink say the goals go begin flow like a river but Burundi girls hold on to make sure say e no pass dat 4-0.

As e be now, the Super Falcons finish the group with 6 points so dem carry second behind South Africa wey collect all the available 9 points after dem beat Botswana 1-0. Naija babes go okay dem quarter final match against Cameroon women on Thursday inside the city of Casablanca.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version