As e dey Go

Super Falcons kpokpo Botswana 2-0 to finally kickstart dem WAFCON campaign

Published

on

Naija women national team, the Super Falcons don finally push-and-start dem Women African Cup of Nations (WAFCON) campaign after dem kpokpo Botswana Women 2-0 for dem second Group C match wey shele last night inside Rabat for Morocco.

The girls start the match well dey control possession sotay at a point the possession na 81% to 19% in favour of the Falcons. But e be like say the Botswana babes plan na to pack bus because dem jus dey jam-jam our babes anytime our girls reach dem 18-yard box to make sure say dem defend well.

Super Falcons players, Asisat Oshoala and Francesca Ordega dey shalaye after them lose dem first match 2-1 to South Africa

But Falcons finally break Botswana defence for 21 minutes when Ifeoma Onumonu allow one through ball roll ahead before she clip the ball small to beat Botswana keeper wey dey rush come outside to make am 1-0 for Falcons. Anumonu only replace Asisat Oshoala for line up after she collect injury for the first match against South Africa wey rule her out of the competition.

The second goal come for second half when Christy Ucheibe wey just come from bench replace Rita Chikwelu score with her first touch after she connect Toni Payne corner kick with one powerful header for the 48th minute to make am 2-0. She nearly make am 3-0 from another header but da wan just go wide.

Botswana babes try to come out but Chiamaka Nnadozie wey dey post for the Super Falcons just dey cool the whole defence down and the Falcons hold on to secure dem first 3 points of the competition. As e be now, Naija dey 2nd for Group C behind South Africa wey dey 6 points after beating Burundi girls 3-1. Naija next match na against Burundi.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version