Wetin shele gan-gan

Super Falcons don lose dem WAFCON third-place match 1-0 against Zambia

Published

on

Naija Super Falcons don lose dem Women’s African Cup of Nations (WAFCON) third-place match after Zambia Women beat dem 1-0 for the game wey shele inside Casablanca for Morocco there.

Diswan go make an the first time since 2012 (10 years) wey the Super Falcons go finish outside the Top 3 of any WAFCON competition and the first time wey Zambia go finish for the Top 3.

Walai talai the girls no play like say dem wan win dis game and we no come know weda na the money wey NFF dey owe dem naim make dem no put body well for dis match because at a point you go see am say the girls just dey lack motivation.

Zambia Women don finish Top 3 of WAFCON for the first time in history

Na Zambia Women open the scoring through own-goal when one bad shot wey Zambia player shoot nak post still bounce hit Super Falcons keeper, Chiamaka Nnadozi then enter net to make am 1-0 for Zambia inside first half.

The Super Falcons try to come back anyhow but dem jus dey miss goals dey faya all dem shot off target like say dem plan. Na wetin the babes do until 90 minutes expire to make sure say wetin never happen inside 10 years finally happen today as Naija Women no finish inside the Top 3.

As e be now, the Super Falcons don lose 3 out of 6 matches wey dem play for the WAFCON; 2-1 against South Africa; 5-4 on top penarity against Morocco; and now 1-0 third place match against Zambia.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version