Wetin shele gan-gan

One Messi fan don lose him cleaner job after collecting Messi autograph

Published

on

No be only good good thing dey happen inside Miami since wey Lionel Messi enter the city because we don dey hear now say one Lionel Messi fan wey dey work as cleaner inside Inter Miami stadium don lose him job after him lose focus of him work just to collect Messi autograph.

According to the tory, the Messi fan, Mr Cristian Salamanca wey leave him village for Columbia enter America just to find work, finally get work as cleaner inside Inter Miami DRV PNK Stadium. But him first day for work naim turn out to be him last day as well when him decide say Lionel Messi autograph important pass the work wey him just get.

Cristian really plan the thing well because him wear Argentina jersey under him overall when him resume shift for the gate wey Inter Miami players go pass enter for dem last match against Orlando City. Na Lionel Messi enter last and immediately Cristian see Messi, him begin hail am like all this agberos dey hail big man for road dey call am Odogwu, Big Shoe, World Champion etc.

Immediately Lionel Messi turn to look who dey hail am like Pasuma so, na so the bros open him overall to reveal him Argentina jersey. Na da wan sweet Messi bele well well wey make am kukuma waka come meet Cristian use marker take sign autograph for the bobo Argentina jersey.

Messi fans dey worship am like god

The autograph make the Messi fan happy well well but him happiness no last because stadium workers get one law say dem no go harass players or even ask dem for autograph while on duty. Na dat rule naim Cristian break and immediately naim one security man come arrest am escort am go dem oga kpatakpata office where dem sack am with immediately alacrity.

But the Messi fan don come outside dey yan say if dem like make dem sack am 1 million times, dat single autograph wey him collect worth am well well. E say although him no like the way wey dem treat am, him no get any bad feelings because Messi don already give am everything him need.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version