As e dey Go

Miami mayor wan use Messi name take cash out on top kalo-kalo

Published

on

My people no be only Naija politicians dey like use superstar name take cash out because the Mayor of Miami, Francis Suarez don plan how to cash use Lionel Messi name take cash out because the man don arrange one better kalo-kalo wey him go run on top him people head.

According to the tory, the Mayor don go arrange 2 tickets to Lionel Messi first match for Inter Miami wey cost about $1,250 each. Then e use am take run promo say you can win dat ticket if you pay just 1 dollar to one account wey carry him name.

In the end, dem go do raffle draw to take determine who go win the two tickets. The man dey expect say hundreds and thousands of people go pay 1 dollar for the raffle draw. So him go use $2,500 take hammer more than $100,000.

We hear say oga Francis Suarez wan add the money to him campaign money as him dey plan to run for presidential election to become the next president of America. Na diswan make people dey wonder which kind kalo-kalo campaign dis man wan to dey run so.

Inter Miami finally unveil Messi as dem new player yesterday. This one shele as the club don lose 8 and draw 3 of dem last 11 league matches wey don make fans don begin beg Lionel Messi to come quick come save dem from dis kind calamity.

Lionel Messi go play him first match for Inter Miami on Friday.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version