As e dey Hot

Naija Super Falcons don beat Cameroon 1-0 to qualify for WAFCON semi finals

Published

on

The Super Falcons of Nigeria don qualify for dem 9th straight Women’s World Cup after dem qualify for the semi finals of the Women Africa Cup of Nations (WAFCON) by beating Cameroon 1-0 for dem quarter final match.

The first half be like say na gidigbo naim Cameroon girls come fight, not football because the way dem just dey jam-jam Naija babes, those ones no even see anytin play. Cameroon jam Naija babes sotay two of dem get yellow card inside first half.

Rasheedat Ajibade don become the joint top scorer of the completion with 3 goals

But na for second half naim Super Falcons begin express demsef dey show all working until the 57th minute when Onumonu use one wucked pull out take locate Ajibade wey con use one wucked heading take scatter Cameroon net to make am 1-0 and register her Number 3 goal of the competition.

Cameroon pack demsef come outside to hustle equalizer sotay dem pack demsef full Naija post like OBIdients wey dey do 1 million march. Dem hustle dis goal with all dem power sotay one of dem nearly break Super Falcons keeper hand. But the Naija girls hold on to nak Cameroon dem first loss of the entire competition.

As e be like dis now, the Super Falcons don become the only African team to qualify for every FIFA Women’s World Cup since 1990 wey dem start am. Dem don guarantee $250,000 by qualifying for dis semi final and about $750,000 for qualifying for the World Cup.

Naija go play Morocco wey dey host the competition for dem semi final match.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version