As e dey Hot

Naija Super Falconets beat Canada 3-1 to maintain 100% record for U-20 Women’s World Cup

Published

on

Naija U-20 women’s team, the Super Falconets come from behind to beat Canada 3-1 to make sure say dem collect all the 9 points take top dem Group C and maintain dem 100% winning record for the FIFA U-20 Women’s World Cup wey dey shele inside Costa Rica so.

Dis na the first time wey any Falconets team in the history of Falconets dey qualify from dem group with the full 9 points.

Canada babes rush score early goal take maja the Falconets but our girls show dem say no be who first call police dey win case after dem pressure Canada sotay dem concede 2 penarity inside first half. Esther Onyenezide convert the penarity to make am 2-1 after half time.

The Super Falconets celebrate dem goal against Canada

The Falconets continue dey Obidiently apply pressure until the dying minute when Chioma Olise’s complete am 3-1 to make sure say the Falconets do Canada 1 pay 3. This na the first time wey the Falconets go concede goal for the competition as well as the first time wey dem dey score more than 1 goal for match.

 

Dem beat France 1-0 for dem opening match before beating South Korea 1-0 for dem second match. As e be now, the Falconets go jam Netherlands wey win 2 of dem group stage matches take carry second for Group D for the quarter final wey go shele on Sunday.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version