As e dey Hot

If Harry Kane know wetin good for am make e no do mistake join Bayern -Owen

Published

on

Liverpool legend, Michael Owen, don come out with him full chest dey warn Harry Kane sey make him nor do mistake join Bayern Munich even though dem don agree £95m to sign am from Tottenham.

Michael Owen wey be Premier League legend shelaye sey the reason why him no want Kane to rush to join Bayern na because beating Alan Shearer record as the highest goalscorer for Premier League history go be bigger achievement pass winning any trophy with Bayern Munich. According to am :

‘If to sey nah Real Madrid or the top 2 clubs for Premier League Harry Kane wan go, I go understand. But dat German league wey Kane wan go so nah one team league. I nor get any problem with Bayern o. I respect dem but if nah me be Harry Kane, I go stay for Tottenham so that I go beat Alan Shearer record as the highest goalscorer for Premier League history because na da wan go give an legacy pass.

Bayern Munich and Tottenham don agree deal wey go carry Kane go Germany ontop 5 years contact for £95m. If this deal go through, nah this deal go be the most expensive for Bayern history. This Kane deal go pass the one wey carry Lucas Hernandez come Bayern ontop €80m.

Harry Kane score 30 goals last season alone

Alan Shearer nah the highest goalscorer for Premier League history with 260 goals and Harry Kane wey don score 213 goals fit nor pass dat record if him join Bayern even if him return after 5 years.

But if him remain for the league even at 30 years old, nobody go fit bet against am say him no go smash dat record even put jara on top. Kane dey score average of 20 goals per season. The Tottenham hit man score 30 goals for 38 matches last season.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version