As e dey Hot

I no blame anybody wey think say Lionel Messi matches dey scripted – David Beckham

Published

on

Football legend and owner of Inter Miami, oga David Beckham don come outside dey yan say him no blame anybody wey dey talk say Lionel Messi matches wey him dey play for Inter Miami dey scripted because the way Lionel Messi dey play no be like wetin regular players dey play.

David Beckham say him wish say na him write the script because the story too sweet, in fact the thing dey sweet Beckham pass some movies wey dem dey show for cinema and the oga kpatakpata no even want make the script end anytime soon.

Inter Miami end last season for the bottom of the Major League Soccer (MLS) Eastern Conference table. This na before the club enter market go buy Lionel Messi, Sergio Busquets and Jordi Alba and since then dem life never remain the same again. Since these 3 players land the club, dem don play 8 matches and dem win all.

Some of those matches like the one against Cincinnati last night, dem go come from behind to win the match. And na Lionel Messi dey lead the comeback. Right now, the World Cup winner don score 10 goals in 8 matches since joining the club.

Messi dey do very well for Inter Miami

Na this one don make some people dey talk say na plan dem plan the whole thing to make Messi look like one god of football. But David Beckham don dey tell dem say for people to think say dem plan the thing na very big compliment to the players. According to the Manchester United legend:

Everytime wey Messi score, or Busquets throw magic pass, or Jordi Alba make those wicked runs, people go say na script. And I agree with dem. Na script true true because the thing look like movie, sometimes me sef no dey believe am.

Beckham say na the way these players dey make ball easy as sweet naim make people dey think say na scripting and e dey happen well well especially when people no understand wetin dem dey see.

Inter Miami win dem first-ever trophy last weekend when dem beat Nashville 10-9 on top penalties to win the Leagues Cup. Now dem don qualify to play the US Open Cup final after dem beat Cincinnati 5-4 on penalties.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version