As e dey Hot

Golden Eaglets lose 1-0 to Morocco for dem second U17 Afcon match

Published

on

Naija Under-17 national team, the Golden Eaglets don lose 1-0 for dem second Group B match inside the ongoing U17 AFCON completion wey dey shele inside Algeria.

Immediately match start wey Morocco pass the kick off naim dem carry the ball shoot one shot wey deflect inside net to make am own goal for Tochukwu Ogboji and 1-0 for Morocco.

But the Golden Eaglets take over from there begin press Morocco dey pressure dem sotay dem no even fit cross halfway line. But the problem be say whenever dem get opportunity dem dey miss am anyhow, even some clear chances wey dem just dey balloon anyhow.

The boys enter second half continue dey press Morocco while the Atlas Cubs continue dey defend like say dem life depend on am. But dat wan no stop the Naija boys from breaking dem down but the problem be say, even from close range all the Eaglets shot just dey go off target.

The Atlas Cubs of Morocco beat Golden Eaglets 1-0

Una remember say Super Eagles skippo, Ahmed Musa promise this boys N500,000 for each goal wey dem score for dis competition. We no come know whether na dat promise dey affect dem wey dem go see big chances dey miss am upandan.

The Atlas Cubs secure all 3 points for the match and dem second clean sheet of the competition. As e be now, Morocco dey top Group B with 6 points while Naija dey second with 3 points.

The Golden Eaglets go play South Africa next on Saturday to decide whether dem go qualify directly from the group or qualify as best losers since na only 3 groups dey the competition.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version