As e dey Hot

Golden Eaglets don jabo from U17 AFCON after Burkina Faso beat dem 2-0

Published

on

The Golden Eaglets of Nigeria don jabo from the 2023 U17 AFCON championship after Burkina Faso beat dem 2-1 for their quarter final match wey shele dis night inside Algeria there.

The match open from the beginning sotay the two sides dey get opportunity wey dem just dey squander anyhow.

But na calamity defending lead to Burkina Faso first goal when one Burkina winger collect the ball from the right, cancel 2 Naija defenders before bending the ball wey keeper save. But instead of defenders to clear the line, dem dey there dey drag leg until Aboubacar Camara put am inside net to make am 1-0.

Burkina Faso beat Golden Eaglets 2-1

 

The boys enter second half begin play under pressure and na another defensive error cause the second goal after one Burkina striker push ball inside 18 only for Naija defender to bring am down clumsily for penarity. The same Aboubacar Camara naim coolly convert the pk to make am 2-0.

But the boys no give up on demsef as dem begin dey pressure Burkina Faso until one ground crossing come in from the left wey one Naija striker flick enter Abubakar Abdullahi leg to tap in to empty net make am 2-1 and game on.

The boys try dem best to equalise but as usual, their inability to score goals become their biggest problem as Burkina Faso hold on to nak Nigeria comot for the 2023 AFCON U17 championship.

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version