As e dey Go

Former Portsmouth player wey dump football for teaching job say him no regret am

Published

on

One former Portsmouth player wey abandon him professional football career to focus on secondary school teaching job don come outside dey shalaye say him no regret that decision at all at all. The player, Joe Hancott retire from football back in 2021 when him dey just 20 years old.

But if you look Joe starting you no go believe say the bros go end quickly like that. The bobo break into Portsmouth first team back in August 2017 when him dey just 16 years old. In fact Joe break the record to become the youngest player to ever play for Portsmouth. Na the current Wolves Coachie, oga Gary O’Neil been hold that record.

Because of diswan naim make many people begin believe say Joe na special talent wey go go very far. Na so dem send Joe out on loan make him go dey get regular playing time but unfortunately, the bobo no even see single match player.

But Portsmouth continue to dey believe in the boy even when injury begin give am problem and him game begin drop badly. Dem still dey nak am new contract on top heavy scholarship believing say na good investment and when dem sell am to big clubs, dem go make hooge money.

Joe Hancott don become PE teacher for secondary school

Na when Portsmouth wan nak am the new 6 month contract plus scholarship for 2021 naim Joe tell dem say nna shay suffer no dey taya una? And na like so Joe take give up on football. And now, two years later, Joe Hancott say him no regret am at all. According to the 22 years old boy:

”At the time wey I retire, football no dey sweet me again. In fact I don fall out of love with the game. I still love to watch am for TV or for stadium o, but to enter pitch as a player, I don already comot body. Maybe na because of all the injury and the stress as a defender wey I be, but regardless, the tin don taya me.”

As God may have it, Joe don already begin study sports management for open university even before him retire and immediately him finish the course, him secondary school employ am to become their PE teacher. So na dat teaching job the bobo take dey hold side right now.

Joe Hancott don begin play football again for Wessex Football League wey be the 9th division for England. But whether him go ever decide to join the big boys again naim we no come know again. At just 22 years old now, time still dey him side.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version