Wetin shele gan-gan

Chelsea hammer Wrexham 5-0 for pre-season friendly

Published

on

Chelsea don show Wrexham the difference between Premier League and Division 2 after hammering dem 5-0 for their pre-season friendly wey shele last night/early mor-mor.

Even though the match shele for Chapel Hill wey people dey go pray inside Kenan Memorial Stadium for North Carolina, USA,  Chelsea no use church mind take play the match as goals from Ian Maatsen, Connor Gallagher, Christopher Nkuku and Ben Chilwell ensure sey dem start their pre-season well.

When you torchlight the squad, you go see sey nah mostly new faces dey the team. Nah Cumming start for post as Malo Gusto play right back while Challobah and Humphreys play 5 and 6. Na Cucrella complete the backline for 3.

Andrey Santos and Cesare Casadei play double 4 for midfield while Diego Moreira, Carney Chukwuemeka and Maatsen play behind summer signing Nicholas Jackson.

Chelsea start the match like sey nah Champions League final with sweet passes upandan before Maatsen burst the match for the 3rd minute after Jackson show why dem pay £32m ontop him head to lay the assist. 5 minutes before halftime nah in Maatsen score him second goal of the match after combining well with Moreira wey dem sign from Benfica and Carney Chukwuemeka.

Pochettino make many changes after halftime as Christopher Nkuku wey join from Leipzig, Connor Gallagher, Ben Chiwell and Raheem Sterling enter the match. The only attempt wey near goal for Wrexham come from their top striker for their last two seasons, Paul Mullin with shot wey go over. Then, 15 minutes to the end of the match nah in Lucas Bernstrom enter for Humphreys.

E nor tey wey Bergstrom enter wey Wrexham nearly use corner score. Nah this one wake Chelsea up wey Sterling carry ball begin dribble like Ronaldinho come set up Gallagher for the 3rd goal of the match. Christopher Nkuku score the 4th goal almost immediately after Casadei give am one sweet pass and nah Chilwell score the 5th and last goal wen Angelo Gomes show why dem sign am from Santos last week play one sweet through ball give am.

 

This one don mean sey Chelsea don begin their pre-season well and as dem dey travel go Philadelphia for their Premier League Summer Series, Chelsea fans go dey hope sey this match nah sign sey this season go different from last season wey Chelsea play like Okorogbo United. Nah Brighton dem go play for their first match.

 

 

 

 

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version