Wetin shele gan-gan

Armed robbers attack Aubameyang house, kpokpo him face thief all him bling-bling

Published

on

My people diswan na very worwor tory as we don dey hear now say some armed robbers attack Pierre-Emerick Aubameyang house inside Barcelona for Spain, kpokpo the former Arsenal captain well well before dem begin steal things from the house.

According to the tory, na for middle of night when the whole Aubameyang family dey enjoy dem Sunday sleep naim the bandits burs enter the house through the garden fence begin show all working.

Dem first use gun take threaten Aubameyang before dem lie am for ground in front of him wife begin punch am dey kick am even use iron rod take dey hit the guy like dem dey beat thief for Oshodi sotay him wife begin hala whether dem wan kill am.

Aubameyang, him wife Alysha Behague and dem two children inside the house

After dem don beat the guy beleful naim dem begin waka from one room to another dey thief everything wey dem fit carry. Dem enter Aubameyang kolo carry some money wey dem see before clearing all the guy bling bling from him gold necklaces to diamond neck chain, earring, nose ring, wristwatch, everything wey dey shine for eyes naim the hoodlum dem clear from the house.

As e be now, Barcelona police don dey on top the matter as dem dey try track down those arm robber dem. Aubameyang sef no gree go hospital because him no want make dem use bandage and plaster take decorate all him head and face so dat him pikin dem no go begin fear.

Aubameyang wey join Barcelona from Arsenal for January dey work on possible transfer wey go carry am back to London with Chelsea. The transfer don dey tay small but we no come know whether dis attack go make Aubameyang fast forward the movement make him relocate quick.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version