As e dey Hot

Arsenal nearly buy 14 years old Mbappe but their igbakugba make the boy reject them

Published

on

We don dey hear now say na small thing remain Arsenal don nearly sign Kylian Mbappe carry am come London for 2013. This na according to one former Arsenal scout, oga Gilles Grimandi.

According to Grimandi, Mbappe dey just 14 years old then dey play for AS Bondy Academy. Him contract with Bondy remain just 4 months and nobody know who him be then. So Grimandi talk to am and him don agree to join Arsenal finish. Then him come dey watch Arsenal matches dey see all the igbakugba wey them dey play come change him mind.

According to the former scout: “I know say as a scout I go discover some players at the same time lose some other ones but losing Mbappe then pain me well well o. Because if to say Mbappe join Arsenal, him for don change the club life by now. But then Arsenal dey play igbakugba and no player with bright future go wan go there.”

Mbappe finally decide to join Monaco instead and even when him finally wan leave Monaco, Arsene Wenger visit am dey beg am to join Arsenal but the World Cup winner no gree join because even as at then nothing don change for Arsenal.

Now Mbappe dey share pitch with big big players like Neymar and Messi for PSG

If you check well, by 2013, Arsenal don go nearly 10 years without winning any trophy. In fact some few months earlier, Arsenal coachie then, oga Arsene Wenger don yan say to finish top 4 na trophy. So for a club wey get that kind mentality, attracting the best players wey get ambition go hard.

Mbappe no be the only player wey Arsenal under Wenger nearly sign sha as we don hear say Wenger nearly sign players like Robinho, Ronaldo, Messi, Hazard, Benzema, Neymar and many many others.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Trending

Exit mobile version